- 歌詞
- 專輯列表
Erigga
-
Industry Nite (Refix)
na if you hear say i die say person shoot me will you cry or say na wetin my mouth put me what if you hear say na one robbery when i go cause i don tire for underground i just wan blow shoot videos wen bad like them daddy yo put am for trace hiptv and mtv-o oliru o sunday scatter G-twelve bar enter cotonou go buy like twenty-m car na in those days these talents fit blow you nowadays without money nobody wan know you
presenters want their share even dj's too 100k each
which show these upcomings dey do
get the nerve say erigga shoot with clearance under this reccession how much dey the balance the industry for nigeria be like campaign share the money PDP if you wan reign e be like say nah endorsement be the new swag even if money no follow you fit take am brag label dey spend big money for artiste head but the artiste no go show many artiste dead now for you too live the label be like like concre work very hard because of wetin dem don spend on-top cos your boss dey expect hundred million afterall this song blow were the hundred million Now label don cast e don go to 'G' back word on the street dem collect the house and jeep back same girls when dey dance when dey hear ypur beat na dey take you do yeye when they hear your gist
welcome to industry nite na you dem dey host today you go perform right for your mind all these men when dey here love you but when dey reach their various houses dem go judge you(twice)
(...)
A trip to the south you no need visa
king of the south to your door like domino pizza
the way my rap big i dey fear make you no drown 更多更詳盡歌詞 在 ※ Mojim.com 魔鏡歌詞網
one stop to my money long pass devil gown
A trip to the south EP use your eyes listen
and mouth look better learn the industry is missing
rappers dey fear dem no believe say i go blow one day
heart dey beat anyhow like who follow one way
if na beef you dey find i shade am like suya
salamaleku my kala dey reply puya
tell your producer orhh
use eim number text you
say better beef dey
you come studio we mess you
na me na own the throne you just dey stone the throne
na street catry am give me i no fit bone the throne
my teacher tell me say nah army gun go shoot me die
but instead nah clearance dey shoot me guy
the day annonimous call me i dey jungle dey smoke
sign contract i never start industry don dey smoke
i don big pass who dey write na straight from my head
commot your leg for wire warri say abegg
-
|